How Godswill Akpabio deny Joy Nunieh accusation for NDDC probe and im full testimony to di House of Reps

0
307

Nigeria Minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio don deny all di accuse wey Joy Nunieh, former MD of Niger Delta Development Commission sama accuse am.

During di public hearing wey di House of Representatives Committee on NDDC do today, Senator Akpabio say im no hijack di forensic audit of NDDC and im no sack any staff of di commission.

Oda tins wey Senator Godswill Akpabio tok

Senator Akpabio engage in serious back and forth with di committee members as dem dey throw different question give am;

  • Senator Akpabio say di job of di minister of Niger Delta Affairs na to supervise and not to run di NDDC
  • Akpabio say e no get any presidential ambition.
  • E no tell any staff to bring 10bn
  • No one naira wey anybody pay give am as di minister and e no ever do contract for NDDC.
  • N40bn no fit miss for di account of NDDC because of di TSA account wey dem dey operate
  • Di last IMC of NDDC no spend N8bn, di total expenditure na about N23bn
  • Even before di coming of Covid, 60% of di commission budget na on medical expenses.
  • Only three contracts na im dem award since e enta on board for NDDC and dem be- di forensic audit contract, purchase of vehicle contract and Covid-19 contract
  • NDDC dey wia e dey today because of lack of monitoring, lack of supervision
  • NDDC files no dey miss, dem don handover them give di forensic audition
  • E say im no dey aware of how much NDDC pay for di forensic audit
  • Akapbio say 60 percent of NDDC contracts dem award am give National Assembly members. Dis tin wey im tok come lead to serious gbas gbos between im and one committee member wey bin ask am wetin di national assembly dey benefit from NDDC
  • E say e go need di cooperation of di national assembly to stop di splitting of contract inside di NDDC plus reposition di commission

Source: BBC

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here